but I go let Solomon pikin keep one tribe, so dat my savant David, shidren-shidren go fit dey rule for Jerusalem, di town wey I don choose sey dem go for woship mi.
Hezekaya die and dem beri am for David shidren-shidren grave. Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem beri am with honor. En pikin Manasseh kon take-ova as king.
God wey get pawa sey, “I go attack and skata Babilon. I nor go leave anytin or pesin for der; nobody go survive at-all and pipol nor go remember am again. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.
Na Yu bi di hope wey Israel get; so make Yu disgrace doz wey leave Yu. Make dem disappear like name wey dem rite for san, bikos dem forget Yu wey bi di spring wey dey bring fresh wota.”