30 Raitious pipol go always dey save, but wiked pipol nor go stay long for dis world.
But doz wey get good heart, dey do wetin dey rite and di ones wey get klean hand, dey strong evriday.
Evil nor go fit kill doz kind pipol. Pipol wey dey raitious and good, pipol dey always remember dem.
Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.
Some pipol dey borrow money give odas without intrest and dem nor dey kollect bribe to lie for pesin head. Di pipol wey dey do dis kind tins, go stand gidigba forever.
I don make God nomba one for evritin wey I dey do and bikos E dey for my rite side, I nor go shake or fear anytin.
Na doz wey God bless go get di land, but doz wey E curse, go die.
But God go distroy yu wons and for all. E go remove yu from yor house kon distroy yu from dis world.
Wen heavy breeze dey blow, e go blow wiked pipol trowey, but pipol wey dey tok trut, dey always dey save.
Dem ansa Jesus, “E go distroy doz evil pipol! Den e go hire di farm give oda farmers wey go gi-am wetin bi en own, wen harvest time rish.”