Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 10:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 Di hope wey good pipol get, dey give dem joy, but wiked pipol, nor get wetin dem dey hope for.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 10:28
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But wiked pipol eye go blind and dem nor go si where run go. Di only hope wey dem get, na make deat kom karry dem go.”


Pipol wey nor dey fear God bi like di reed; dia hope don go as dem just forget God.


Wen wiked pipol si dis tins, dem go dey fear and worry; dem go grind dia tit dey vex; dem go melt trowey and evritin wey dem wont, go distroy.


No wonder happiness full my heart, bikos I dey rest well and fear nor dey my life.


So, make una sing to God! Make una sing praiz en name! Make una praiz di Pesin wey dey ride on-top kloud! Na God bi en name! Make una happy for en present!


Wetin good pipol wont, dey bring good result; but evribody dey vex if wiked pesin get wetin e wont.


Wen wiked pipol die, dia hope dey die with dem, bikos dem bilive on dia own pawa.


Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.


Di sin wey evil pipol kommit dey put dem for trobol, but honest pipol, dey-dey happy and free.


Make una let una hope give una happiness. Make una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray.


I pray make God wey dey give hope, bless una with joy and peace bikos of una faith. So make di Holy Spirit pawa full una body with faith.


Na faith e take buy us so dat wi go enter God grace, di place where wi dey naw. So wi fit boast with God glory wey wi dey enjoy.


Naw I dey pray sey, God wey love and give us betta konfort thru en grace and hope,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ