26 Nor allow lazy pesin work for yu, bikos e go bi like betta wine for yor mout or like smoke wey enter yor eye.
As kold wota dey sweet for dry sizin, na so too savant wey pesin fit trust, dey make belle sweet di pesin wey send am.
To sing for pesin wey nor get peace for mind, bi like sey yu dey remove en klot from en body wen kold dey or rub salt put for en sore.
Just as if pesin kut en own leg komot, na so e bi too to send fool message, bikos na trobol di pesin dey look for.
Lazy pipol, make una learn lesin from di way ant dey live dia life.
Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us, wi dey too holy for una to tosh! Doz pipol bi like smoke for my nose, bikos my vexnashon for dem bi like fire wey nor dey kwensh.
“En oga kon tell am, ‘Yu wiked and lazy savant! Since yu know sey I dey harvest wetin I nor plant and dey pak fruits wey I nor plok,
Make una nor taya, but with di Holy Spirit help, make una serve God with betta mind.
So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.