19 Too mush tok dey make pesin sin, but wise pesin nor dey tok anyhow.
“So nobody won ansa all dis nonsense wey yu dey tok? Na bikos yu too tok make yu feel sey yu dey rite?
I tell mysef sey, “I go dey kareful for wetin I dey do and I nor go sin with wetin I dey tok. I go hold my tongue wen sinnas dey near mi.”
E too tok bad about odas, but if yu get sense, yu go fit kontrol yor mout.
Pesin wey dey judge anoda pesin, nor go fit keep sekret, but yu fit trust pesin wey dey tok trut.
Wise pipol nor dey karry body up, but foolish pipol dey show dia foolishness.
Wetin yu tok fit save or distroy yor life. So yu must asept di result of wetin yu tok.
Make yu dey kareful wen yu enter God temple, bikos to kom meet God make E tish yu, betta pass foolish sakrifice and pipol wey dey offa am, nor know sey wetin dem dey do, nor good.
Make yu tink well-well before yu tok or before yu make promise give God. God dey heaven and yu dey dis eart, so make yu nor dey tok too mush.
Too mush tinkin dey kause bad dream and di more yu tok, di more yu go dey tok like fool.
My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.
bikos wi dey make many mistake. If pesin nor dey make mistake for wetin e dey tok, dat mean sey e dey pafet and e go fit kontrol en body.