As e dey tok, King Amazaya kon tell am, “Na who choose yu to advise di king? Make yu stop to profesai or dem go kill yu trowey!” Di profet stop kon sey, “I know sey God one distroy yu, bikos of dis tins wey yu do and yu nor gri listin to my advise.”
Nor allow yor mout make yu sin and nor go defend yorsef give pastor sey, “Na mistake I take make di promise.” Dat kind tin go make God vex for yu and E fit distroy evritin wey yu don work for!
Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?