Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 10:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 If pesin get sense, e dey show wen e dey tok, but if yu dey foolish, na stik dem go take beat yu.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 10:13
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, make yu nor bi like horse or animal wey nor get sense and wey nid kane to kontrol am.”


Doz wey dey fear God dey advise pipol well and dem dey tok wetin dey rite.


God tell Moses, “Make yu stresh yor hand face Egypt, so dat di lokust go kom kover evriwhere and dem go chop all di plants wey dey grow wey di ice-blok distroy remain.”


Many pipol dey gain from word wey betta pesin tok, but stupid word fit kill pesin.


Raitious pipol dey tok with sense, but anybody wey dey tok bad tins, go die.


Evribody dey like good ansa, but e dey good to tok di rite tin for di rite time!


Na good advise dey kom out from wise pipol mout; but foolish pipol heart nor get anytin to give.


Yu go no pesin wey wise and dey mature bikos of di undastandin wey e get. As en word sweet rish, na so too e dey give pipol hope.


Pesin wey get sense dey take korreshon if dem korrect am wons, but foolish pesin go only take korreshon afta dem don beat am well-well.


Just as dem dey beat foolish pesin, na so too dem go ponish doz wey dey karry body up.


To tok with wisdom, betta pass to get gold and silva.


E dey eazy to whip horse and kontrol donkey, but e nor eazy to kontrol foolish pesin.


Even if yu beat foolish pesin almost die, yu nor go fit beat en foolishness komot for en body.


But man wey dey sleep with anoda pesin wife, nor get sense at-all and e just dey distroy ensef by ensef.


Small time, e bigin follow am like melu wey dem won go kill and like animal wey waka fast enter trap


God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.


Evribody dey tok good about Jesus, dem sopraiz for di sweet-sweet word wey dey kom out from en mout. So dem kon ask, “Dis nor bi Josef pikin?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ