Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 1:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 1:5
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As e dey tok, King Amazaya kon tell am, “Na who choose yu to advise di king? Make yu stop to profesai or dem go kill yu trowey!” Di profet stop kon sey, “I know sey God one distroy yu, bikos of dis tins wey yu do and yu nor gri listin to my advise.”


“Men wey dey undastand, make una listin to mi! God Almighty go fit do wetin dey wrong?


“Naw, make yu listin to mi. If yu get undastandin, make yu hear mi.


“Wise men, make una listin to my words; Make una hear mi, men wey know well-well.


True-true, anybody wey get sense go gri and if wise man hear mi, e go tok sey,


Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.


Pipol wey karry body up dey find wisdom, but dem nor go si am, but undastandin dey eazy for pesin wey get sense.


Wise pesin dey always look for knowledge and en mind dey find wisdom.


E good make dem ponish who dey karry body up, so dat pipol wey nor know anytin, go get sense. As wise pesin, yu go get more wisdom wen yu take korreshon.


Wen God ponish pipol wey dey karry body up, even pesin wey nor dey tink, dey learn lesin. If dem tish wise pesin, e go wise well-well.


Make una listin to wetin I dey tish una kon get sense. Make una nor rijet dem.


So, nor ever korrect proud pipol, bikos dem go hate yu; but if yu korrect wise pesin, e go respet yu forever.


Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more. Anytin yu tell raitious pipol go give dem undastandin.


I don still notis anoda tin for dis world sey; nor bi who run pass dey always win di race and nor bi di sojas wey strong pass, dey always win di war. Wise pipol dey hongry sometaims and just as pipol wey dey work hard nor dey always get money, na so too pipol wey know book nor dey always get betta life. All dis tins dey happen by shance, as long as yu dey di rite place for di rite time.


I dey tok to pipol wey get sense. Make una tink about wetin I dey tok.


So make una dey sure sey una dey do dem, bikos dis tins go show how una get sense rish among di pipol wey go hear am and dem go sey, “True-true, dis great kountry get pipol wey wise well-well.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ