33 But anybody wey listin to mi, go dey save and e nor go get rizin to fear.
If dem hear God word kon serve am, dia life go get peace and dem go prosper.
How I wish my pipol go gri listin to mi! How I wish sey Israel pipol go follow mi kon do as I tell dem!
Wahala nor fit kom meet doz wey dey fear God, but na trobol dey always follow wiked pipol.
Doz wey dey fear God, dey save and God dey guide dia shidren.
Wisdom go add more years to yor age.
If pipol wey sin hundred times still get long life, den I know sey pipol wey dey fear God, na dia life go long pass.
Oga God, Yu dey guide and save pipol wey dey faithful, bikos dem trust Yu.
and bikos evribody dey do wetin dey rite, peace and sekurity go dey der forever.
If to sey una just gri listin to my kommand, una peace for bi like river and una raitiousness for bi like wave for sea.
My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.
“ ‘Una must obey my law and my kommandment, so dat una nor go fear for di land.
Di land go produce food and una go chop until una beleful and una nor go fear for di land.
As e still dey tok, one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey, “Dis na my Pikin wey I love. Make una listin to am!”
So, if una stand rish di end, God go save una.”
And wen una hear rumor about war and wahala, make una nor fear. Bikos all dis tins go first happen, but dat nor mean sey di end don rish.”
and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.