Even if dem fast, I nor go listin to dia kry for help and if dem offa burnt and korn ofrin, I nor go asept am. Instead I go kill dem for war and with diziz and honga.”
So, dem go feel my strong vexnashon. I nor go sorry or pity for dem. Dem go shaut well-well as dem dey pray give mi, but I nor go ansa or listin to dem.”
“Pipol go dey waka up-and-down from Dead Sea go Mediterranean Sea kon from nort go east. Dem go dey find God message for evriwhere, but dem nor go si am.
But wen una dey trobol, una go kom beg God make E help una! Una dey espect sey God go ansa una? Afta all di wiked tins wey una don do, God nor go even look una face!”