Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 1:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Una nor gri take my advise or allow mi korrect una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 1:25
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even as God warn Manasseh and en pipol rish, dem nor gri listin.


But dem laf God messenjas, rijet en warnin and en profets. At last, God vex for en pipol and nobody fit stop am wen E dey vex.


bikos dem go against God word, dem nor gri listin to wetin di Most High God tok


But my pipol nor gri listin. Israel pipol nor wont make I dey with dem.


Una nor wont my advise or listin to mi wen I dey korrect una.


Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.


Anybody wey nor gri do wetin dey rite, go sofa well-well and anybody wey nor like korreshon, go die.


Den yu go sey, “Why I nor follow wetin dem tish mi? Why I nor let dem korrect mi?


Kommon sense and suksess na my own. Na mi get undastandin and pawa.


So, mi wey bi Israel God dey sey, ‘I go distroy Judah and Jerusalem pipol, even don I bin don promise dem good tins. I go do am, bikos una nor dey gri listin to anytin wey I tok and wen I koll una, una nor dey ansa.’ ”


But di Farisee pipol and di law tishas rijet wetin God plan for dem, bikos John nor baptize dem.)


Den wen una kom back, una kom dey kry for God present, but God nor listin to una at-all.


For dat day, una go kry, bikos of una king wey una take una hand choose, but God nor go ansa una.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ