Why my pipol nor ansa wen I go meet dem sey I go save dem? Why dem nor ansa wen I koll dem? I nor get pawa rish to save dem? But I fit kommand di sea make e dry kon turn river to desert, so dat di fish dem go die.
una go die yeye deat, bikos na so una wont am and una nor ansa wen I koll una or listin wen I tok to una. Una nor gri obey mi, instead una kon dey do wiked tins.
So, I go bring wahala and di tins wey dem dey fear, bikos wen I koll, nobody ansa and wen I dey tok to dem, nobody gri listin to mi. Evritin wey dem do dey make mi vex and dia ways nor bi my ways.”
So, mi wey bi Israel God dey sey, ‘I go distroy Judah and Jerusalem pipol, even don I bin don promise dem good tins. I go do am, bikos una nor dey gri listin to anytin wey I tok and wen I koll una, una nor dey ansa.’ ”
So, dem go feel my strong vexnashon. I nor go sorry or pity for dem. Dem go shaut well-well as dem dey pray give mi, but I nor go ansa or listin to dem.”