17 E nor dey good to set trap wen di bird wey yu won katch dey look yu.
Dem nor dey turn to God wey make us get sense; di One wey make us wise pass animals and birds.
Bikos dem dey enjoy to do bad tin and dem always dey ready to kill.
But pipol wey dey do like dat, dey set trap for demsef and na di trap go kill dem.
where arrow go for enter en heart. E bi like bird wey dey enter net and e nor know sey en life dey danger.
Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”
Just as bird for sky know wen to fly, na so too, dove, swallow and crane know wen to shange pozishon. But my pipol nor gri do wetin mi, wey bi God sey make dem do.