8 For dat time, one singol wise pesin nor go dey for Edom land again. Bikos on-top Edom mountin, na der I go for distroy all doz wey get sense.” Na so mi, God, tok.
Zoan leaders na fools! Wise men for Egypt dey give di king yeye advise, if not, wetin go make yu tell Fero sey, “I dey among doz wey sabi rite and wi dey plan to ova-trow yu?”
So I go still do tins wey go dey sopraiz dem: tins wey dem nor go undastand. Wise men nor go get anytin to tok; doz wey get sense nor go fit esplain wetin dey happen.”