Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Obadaya 1:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Una pride don deceive una, bikos una dey stay under rock where una dey save kon build big house on-top mountin. So una dey boast sey, ‘Na who go fit kon meet and attack us for der?’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Obadaya 1:3
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Esau (wey still bi Edom) kon go stay for di hill for Seir.


E win 10,000 Edom sojas for Salt Valley, katch Sela for war kon gi-am anoda name wey bi “Jokteel” and na dis name dem dey koll am kon rish today.


King Amazaya use strong heart take lead en sojas go Salt Valley, where e for fight and win 10,000 Edom pipol.


Judah men katch 10,000 men kon take dem go on-top one hill den trow dem go down till dem die finish.


Dem fit big well-well, dey great and dia head dey tosh heaven,


Pride dey bring distroshon and sturbones fit kill pesin.


Respet dey kom before honor; but distroshon dey wait for proud pipol.


Pesin pride go distroy am, but if e dey honbol, pipol go respet am.


Judah pipol sey, “Wi don hear how Moab pipol dey karry body up. Wi know sey di pipol sturbon well-well, but na empty mout dem just dey make.”


Jerusalem wey dey on-top di valley like rock wey high well-well, make yu listin to mi. I go fight against yu, bikos yu sey, ‘Nobody go fit attack or skata awa town.’


So mi wey bi God dey warn una naw sey, make una nor deceive unasef sey Babilon sojas nor go kom back kon attack una, bikos dem go really kom back.


Una wey dey Moab, make una komot from town go stay for under rocks! Make una bi like dove wey dey build en house on-top rock.


Una pride don deceive una. Nobody dey fear una as una tink. Una dey stay for rock and on-top mountin a nd even doh una house high like eagle own, God go bring una kom down.” Dis na wetin Oga God tok.


Ammon pipol! Why una nor dey faithful and dey boast? Wetin make una dey bilive sey una money go save una kon dey ask, ‘Na who go try to attack us?’


Yu just dey busy dey buy and sell and dis tins kon make yu dey misbihave and kommit sin. So I ask yu make yu komot from my mountin wey dey holy and di angel wey dey guide yu, porshu yu komot from di stone wey dey inside fire.


Esau shidren-shidren wey bi Edom fit sey, “Even doh awa towns don skata finish, wi go build dem again.” But God wey dey lead heaven sojas ansa, “Make una go ribuild dem, but I go still skata dem and pipol go koll una kountry, ‘Di Land wey Wikedness Full’ and dem go koll una pipol, ‘Di pipol wey Oga God go always dey vex with.’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ