Dem sey, “Make una help and defend us from awa enemies. Make una protet us bikos dem dey always attack us. Make una nor leave us naw wey wi don run komot from dia hand.
Abeg! Make una allow us stay with una, so dat una go protet us from awa enemies! Wen doz wey opress us don die and distroshon nor dey again and awa enemies don disappear,
Dis na di message wey e send dem: “Today na trobol day, bikos dem don ponish and disgrace us well-well. Wi bi like woman wey won born, but wi too weak to even push.
Di day wen una go face sirious wahala dey kom and dem nor go fit kompare am with any oda day. Even doh di wahala go too mush for my pipol, dem go survive am.”
God sey, “Tyre pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol and dem nor gri keep di agriment wey dem make with Israel.
Una nor for dey happy wen dem karry una brodas as slaves go anoda land. Una nor for happy at-all wen Judah pipol dey sofa all dis tins. Una nor for tok anyhow for dat time wey Israel dey sofa.