Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Obadaya 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Wen dia enemies dey attack dem, una stand dey look and nor gri help dem. Strenjas attack and karry all dia propaty kon trow dice take divide Jerusalem, but una bihave like sey Israel na una enemy.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Obadaya 1:11
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Nebuzaradan karry all di remainin pipol wey dey di town and doz for wildaness wey run from King Nebukadnezzar, plus evry oda pesin go Babilon.


My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”


Wen una si tifs, una go hail and klap for dem and una dey spend una time with pesin wey dey sleep with who e nor marry.


All of dem gada togeda and dem dey plan against Yu.


Dem wey gada so na: Edom and Ishmael pipol, Moab and Hagrit pipol;


“ ‘Una sey, “Judah and Israel land na awa own. Wi go take evritin wey dey here. Wi nor kare weda Oga God dey stay der!”


Dem trow dice take divide who go take my pipol as slave. Dem sell boys and girls as slave kon use di money take buy wine and karry ashawo.


God sey, “Gaza pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol.


God sey, “Tyre pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol and dem nor gri keep di agriment wey dem make with Israel.


Yet, dem still karry en pipol go as slaves. Dem kill dia shidren for evriwhere for di street. Dem shain and divide Egypt sojas among demsef kon karry dem go as slave.


Na di reward for dia pride bi dat, bikos dem don curse di pipol wey bi Oga God own.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ