20 Wen di kloud dey for di Tabanako for some days, dem go dey dia kamp, just as God kommand dem.
Bikos na so God bi! Na-im bi awa God and E go guide us forever and ever.
Make yu always dey trust God with all yor heart, but nor trust wetin yu tink sey yu know.
Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way.
Dis na di first time wen dem start to travel akordin to di kommand wey God give Moses.
Just as God kommand, Israel pipol go travel or stay one place and as long as di kloud still dey di Tabanako, dem nor go-go anywhere.
Wen di kloud don stay for di Tabanako tey, Israel pipol go do evritin wey God kommand dem and dem nor go travel.
Sometaims, di kloud dey only kom down from evening till morning and wen di kloud don go for morning, dem go kon kontinue dia journey. Weda na day time or nite, wen ever di kloud nor dey, dem go travel.
So make una nor fear doz kountries, bikos di Oga una God dey with una and E bi God wey dey great and wonderful.