Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”
Na di place wey e dey read for God word bi dis, “Dem lead am like sheep go kill and as sheep pikin dey kwayet wen dem dey shave am, na so too e nor open en mout.
Den I si one Lamb wey bi like sey dem don kill-am, but e stand for di throne centre with di for creatures and di twenty-four eldas. E get seven horns and seven eyes wey bi God seven spirit, wey E send enter di eart.