But wetin make mi nor get mind? Wetin make my heart nor happy at-all? I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and my God!
Dem nor win di land with dia swod and nor bi dia own strong hand make dem win, but na yor rite and strong hand with di shinin-shinin lite from yor face, help dem, bikos Yu love dem.
E go give us peace. Wen Assyria pipol kom attack and break enter awa town, wi go choose seven rulers wey go wosh ova us and eight priests wey go lead us.
“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”
Afta eight days, wen all di disciples gada again inside di house and Tomas dey der with dem dis time, even doh sey dem lock all di doors, Jesus show ensef kon stand among dem sey, “Make peace dey with una.”