Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 6:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 “ ‘ “God go bless and protet una;

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 6:24
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go dey with yu! I go guide yu for anywhere wey yu dey go kon bring yu kom back to dis land. I nor go leave yu until I don do wetin I promise yu!”


I sey make Yu bless my shidren-shidren; make dem enjoy yor favor forever. God wey get pawa, don promise dis tin and yor blessing go dey with my shidren forever.”


Make God wey kreate heaven and eart bless una from Zion!


Make Yu protet mi as pesin dey protet en own eye. Make Yu hide mi under yor feada.


So God, make Yu save yor pipol! Make Yu bless Israel pipol wey bi yor special propaty. Make Yu guide dem like shepad kon karry dem for yor hand forever.


Bikos E go kommand en angels make dem protet una for evritin wey una dey do.


“Na mi wey bi God go protet am, I dey always look and wota am. I dey guide am both for day and nite, so dat nobody go skata am.


Na mi wey bi God choose yu to show as I good rish. I go hold yor hands kon guide yu and I go give yu to my pipol Israel, just to fulfil my kovenant. And yu go bi lite to guide oda nashons.


“So naw, God, make Yu hear my prayer and as I dey beg Yu. Make Yu sorry for yor temple wey dem don distroy; so dat evribody go know sey na only Yu bi di God wey nor dey die.


I nor go dey di world again, but dem go still dey inside di world, since I won kom meet yu. Holy Papa, make yor name protet di pipol wey yu give mi, so dat dem go bi one, just as mi and yu na one.


If some strenjas dey for where una for dey woship God for spirit and dem nor undastand una, how dem go take know wen to sey, “Amen”?


Make God grace dey with evribody wey love awa Oga God Jesus Christ with di love wey nor dey die.


Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una spirit.


Den God peace wey pass wetin human being fit undastand, go guide una heart and mind, inside Christ.


Make God wey dey give peace, help una to dey holy go rish di end, so dat for di day wen Christ go kom, una spirit, soul and mind go dey without fault.


and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.


Naw, make all glory bi God own, bikos E nor let una fall and E go bring una kom en present with betta joy wey nor get fault.


For dat time, Boaz kom Betlehem kon greet di workers sey, “Make God dey with una!” Dem ansa, “Make God bless yu too!”


E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ