Yu and yor family go fit chop di breast and di leg wey dem give as special gift and di special kontribushon wey dem give God. Yu go fit chop am for any place wey dey holy. Na yu and yor sons get dis ofrin, bikos na part of di peace ofrin wey Israel pipol give.
Di animal breast na special gift and di rite leg na special kontribushon wey God don take from Israel pipol kon gi-am to di priests. Dis na wetin Israel pipol go give di priests forever.
All di special ofrin for di tins wey dey holy wey Israel pipol give to God, I don give dem to yu and yor shidren forever. E go bi salt kovenant forever to God and na for yu and yor shidren-shidren.”
But if di pesin don die and e nor get broda or sista wey di oda pesin go pay give, e go gi-am to God priests. Dis money na with di ram wey dem go take do sakrifice to make di pesin wey sin, holy.