Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 5:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 If di woman sleep with anoda man, di wota go gi-am betta pain; e nor go fit born again and na curse go follow am among di pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 5:27
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

To am, to dey curse pesin bi like klot wey dem dey wear for body or wota wey dem dey drink or betta food wey e dey chop.


I still si sey, woman wey wont make man sleep with am, dey set trap for am and dis one dey wiked and bad pass deat. Pipol wey dey obey God, go fit eskape am, but doz wey dey sin, go enter di trap.


Di pipol wey I choose go use una name as curse. Mi, God wey bi king, go kill una. But I go give new name to pipol wey obey mi.


I go give dem wahala sotey all di nashons for di world go fear. Pipol go laf dem well-well; use dem dey make yeye kon dey curse dem for anywhere wey I skata dem go.


I go use war, honga and diziz take porshu dem, sotey all di oda nashons for di world go shok, fear, laf and curse dem for anywhere wey I skata dem go,


So wen di pipol wey dem take from Jerusalem go Babilon won curse pesin, dem go sey, ‘Make God trit yu like Zedekaya and Ahab wey Babilon king roast alive!’


Bikos Israel God sey, ‘Just as I pour my vexnashon and fire for Jerusalem pipol, na so too, I go pour my vexnashon for una head, if una go Egypt. Pipol go si una dey fear, dem go hate and use una name as curse. Una nor go ever si dis place again.’


Den, Judah pipol wey remain, wey don make up dia mind sey dem won go Egypt, I go make sure sey, dem distroy dem finish. Both big and small go die for Egypt; weda na for war or honga. Pipol go si dem dey fear and dem go trit dem anyhow kon use dia name as curse.


Judah and Israel pipol! Before-before, strenjas dey curse diasef sey, ‘Make di kind wahala wey fall press Judah and Israel pipol, fall press yu!’ But I go save una and doz strenjas go still tell each oda sey, ‘Make yu receive di same blessing wey Judah and Israel pipol get!’ So make una get hope and nor fear.”


But if I sleep with man wey nor bi my husband,


But if di woman nor do am, den nor-tin go happen and e go fit born again.


So wetin una gain from all doz bad tins wey una do? Na shame and deat doz tins dey bring.


To doz wey don lost, e bi like sometin wey dey kill; but for doz wey Christ don save, e bi like smell wey dey give life. So, who go fit handle all dis tins?


For di place where God go send una go, una go bi disgrace among di pipol for di eart.


Dis na di pipol wey dey do wetin dia body wont and dem nor dey respet pipol wey get authority. Dem nor dey fear; dem dey karry body up; dey tok bad about tins wey God kreate for heaven,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ