2 sey, “God don kommand una make una trow dice take share di land give Israel pipol. E still kommand una make una give Zelofehad awa broda propaty to en dotas.
Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty.
But make una remember sey, if dem marry from anoda tribe, dia propaty go kon bi dat tribe own and di total propaty wey go kon bi awa own, go kon small.
“I go porshu di pipol wey dey doz land komot for my pipol, Israel. All of dem wey dey stay di hill kountries from Lebanon go rish Misrefot-Maim, plus Sidon pipol, I go distroy dem, den yu go give dia land to Israel pipol, just as I tok.