Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 35:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 Israel pipol, make una nor spoil di land wey I dey give una, bikos na mi bi God and I dey stay among una.’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 35:34
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go stay with my pipol Israel and I nor go ever abandon dem.”


and E sey, “I go dey rest for here forever. I go stay der, bikos na mi choose am.


E good make evribody for Zion, praiz God and bikos na en bi God wey dey Jerusalem, make all of us, praiz am!


Make dem build house for mi, so dat I go fit follow una stay.


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


“Make yu nor join di pipol plan and nor fear di tins wey dem dey fear.


I go make dem pay times two for dia sin and wikedness, bikos dem don dirty my land kon pak dia yeye juju wey nor get life, full am.’ ”


“ ‘Una sey, “Judah and Israel land na awa own. Wi go take evritin wey dey here. Wi nor kare weda Oga God dey stay der!”


Israel pipol nor go stay for God land again, but dem go-go back to Egypt, den for Assyria, dem go chop food wey dem dey forbid.


Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”


Weda dem bi man or woman, una must porshu dem komot from di kamp, so dat dem nor go make di kamp unklean, bikos God dey stay der with en pipol.’ ”


make di body nor dey di tree till di next day. Na dat same day una go beri di body, bikos en body wey dem hang, na curse for God eye. Make una nor dirty di land wey di Oga una God dey give una.


So God go forgive en pipol Israel wey E save and E nor go ponish dem sey na dem kill pesin wey nor do anytin.” Den di sin nor go dey dia head at-all.


bikos di Oga una God wey dey here with una, dey jealous well-well and en vexnashon go kill and porshu evry oda tin, until E go distroy wiked pipol and sinnas komot from dis eart.


But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.


And I hear one loud vois from di throne dey sey: “Make yu look! God house don dey with human being naw. E go stay with dem and dem go bi en pipol. God ensef go dey with dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ