Aaron and en sons go dey arrange di lamps from morning till evening before di Oga dia God. Dis kommandment na for Israel pipol and dia pikin dem and e go dey forever.”
But Levi pipol must do di work for di tent where dem for dey do meetin and dem must bear dia own sin. Dis na rule forever for all Levi pipol. Levi pipol nor go get any propaty for Israel,
Den di dotas wey Zelofehad wey Hefa born, wey Gilead born, wey Makir born, wey Manasseh born wey Josef born kon kom. Di girls names na, Mahlah, Noah, Hoglah, Milka and Tirzah.
if en papa nor get brodas, den una go give en propaty to di pesin wey dey klose to am pass for en family and e go take am. Dis go bi law wey Israel must obey, bikos na God kommand.’ ”