27 and if dem kill-am, den who kill-am nor go dey guilty.
“If dem katch tif dey enter pesin house kon nak am die, en blood nor go dey anybody head.
“ ‘If di pesin wey kill pesin komot from di save town wey e hide put
Di pesin wey kill pesin must stay for di save town until di High Priest go die, afta dis, e go fit go house back.
Una must nor kill innocent pesin for di land wey di Oga una God won give una, bikos dat go make una dey guilty.
Bikos if di town too far for am, before e go run rish der, di pesin wey dey vex sey dem kill en pesin fit porshu di pesin kon kill-am. Dis pesin deat nor good, bikos na mistake e take kill pesin.