One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.
“ ‘Wen dem don pour di anointin oil for High Priest head, e don dey klean to wear di garment wey priests dey wear and e must nor komb en hair or tear en garment.