Amasa nor protet ensef against di swod wey Joab hold for en oda hand, so Joab shuk am for belle and en intestine kom out. Amasa just die at wons and Joab nor nid to shuk am again. Den Joab and Abishai, en broda kon go find Sheba.
Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.
or e nak di pesin die, e must die too, bikos e kill pesin. Di family memba go take revensh. Anytime wey dem si di pesin wey kill dia broda, dem go kill-am too.
So make yu nor allow dem deceive yu, bikos dem pass forty wey hide for bush one kill-am. Dem don swear sey dem nor go chop or drink anytin, until dem don kill Paul. Naw, dem dey wait for yu to gri for wetin dem won ask yu.”
Saul kon sey, “Dis na wetin una go tell David: ‘Di king nor wont money for di girl; di only tin wey e wont na hundred Filistia pipol skin, so dat e go pay en enemies back for di tins wey dem don kause.’ ” (Naw, Saul bilive sey David nor go survive dis one.)
David run go Naiot for Rama. E go meet Jonatan kon ask am, “Na wetin I do? Na wish bad tin I do? Na how I take sin against yor papa? Bikos e won kill mi!”
My papa, si yor klot korna for my hand. Wen I kut am komot, I nor kill yu. So make yu know and undastand sey I nor dey plan to kill or fight against yu.