Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 35:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Di pesin wey dem kill, en family memba go take revensh. Anytime wey e si di pesin wey kill en broda, e fit kill-am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 35:19
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Si! Yu dey porshu mi from di land and I must hide make Yu nor si mi. I go dey waka without house for dis eart; so anybody wey si mi, go kill mi.”


Di woman sey, “My king, abeg make yu pray give yor God, so dat my rilashons nor go kommit di crime wey big pass di first one kon go kill my oda pikin.” David ansa, “I use God name take promise sey nobody go tosh yor pikin.”


And naw, my rilashons sey make I give dem my pikin wey remain, so dat dem go kill-am, bikos e kill en broda. If dem do like dis, I nor go get pikin again. Dem go distroy my last hope and nobody go dey again to ansa my husband name.”


Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.


Na so Joab and Abishai wey bi en broda take kill Abner, bikos e kill Asahel dia broda for war for Gibeon.


E go dey save for der from di family wey e kill dia pikin. Anybody wey kill pesin, dem must hear from am first before una go kill-am.


Or if na wood e take kill di pesin, e must die, bikos e kill pesin.


If anybody hate somebody kon push di pesin or use sometin take stone di pesin die


or e nak di pesin die, e must die too, bikos e kill pesin. Di family memba go take revensh. Anytime wey dem si di pesin wey kill dia broda, dem go kill-am too.


for dis kind kase, di kommunity go judge between di pesin wey kill and di one wey won revensh.


and if dem kill-am, den who kill-am nor go dey guilty.


di pesin wey old pass for en family go sey make dem bring am kom, so dat dem go kill-am too.


Bikos if di town too far for am, before e go run rish der, di pesin wey dey vex sey dem kill en pesin fit porshu di pesin kon kill-am. Dis pesin deat nor good, bikos na mistake e take kill pesin.


Anybody wey by mistake kill pesin, fit run go der from di man wey go won kill-am.


Wen di pesin wey won take revensh find am kom, dem nor go let am attack di man, bikos na mistake e take kill di pesin.


So Gideon sey, “Dem bi my brodas, my mama shidren. If to sey una nor kill dem, I swear I nor for kill una.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ