54 Make una divide di land akordin to di tribe and family wey dey among una. Make una give big propaty to di family wey plenty and small propaty to di family wey nor plenty.
Dis towns must bi Israel pipol own. Di tribes wey big go give more land to Levi pipol, while di small tribes go give small land to Levi pipol. Each tribe go give Levi pipol akordin to di propaty wey dem get.”
“I go porshu di pipol wey dey doz land komot for my pipol, Israel. All of dem wey dey stay di hill kountries from Lebanon go rish Misrefot-Maim, plus Sidon pipol, I go distroy dem, den yu go give dia land to Israel pipol, just as I tok.