Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)
Israel pipol, make una listin! Today una won cross Jordan River kon go take doz strong pipol wey get pawa pass una, land. Dem dey stay for towns wey di wall rish di sky!
For Jordan River centre, di priests wey karry di Kovenant Box, stand well for dry groun. All di pipol for Israel cross pass for dry groun until evribody for di kountry cross finish.