Wen di pipol don komot from Sinai, wey bi di holy mountin, dem kon travel for three days. God Kovenant Box dey with dem for dat three days wey dem travel so and dem kon dey find where dem go fit rest put small.
Some yeye pipol wey travel with Israel pipol, get long-trot for meat and dem kon make Israel pipol dey komplain sey: “How wi wish sey wi fit just get some meat chop!