1 Dis na di place dem wey Israel pipol travel go, afta dem komot from Egypt akordin to dia tribe, just as Moses and Aaron kommand dem.
But God send en savant Moses with Aaron wey E choose, go free en pipol.
Den Yu use Moses and Aaron take lead and guide yor pipol like many sheep.
Israel pipol bigin travel with leg from Rameses go Sukkot. Israel men wey travel rish 600,000 (Dem nor kount wimen and shidren join am).
Israel pipol komot for Egypt for di day wey di four hundred and thirty years komplete.
For dat day, Oga God take Israel pipol komot from Egypt akordin to der tribe.
So God lead di pipol pass di wildaness wey face di Red Sea. And Israel pipol prepare demsef for war as dem dey komot from Egypt.
Na dis Aaron and Moses, God still tell sey, “Make una take Israel pipol komot from Egypt.”
Na mi bring and save una from Egypt where una for bi slave. I send Moses, Aaron and Miriam kom help una.
Akordin to God kommand, Moses kon rite di names of each place wey dem stay.
“ ‘I send Moses and Aaron go Egypt kon skata Egypt rish groun wen I enter di land. Den I bring una kom out from Egypt.
“Wen Jakob enter Egypt, una grand-grand papa dem kon kry to God. God send Moses and Aaron and dem lead dem komot from Egypt kon stay for here.