Isaak kon open di well again wey en papa Abraham dig wey Filistia pipol kover afta Abraham don die. Isaak give dis well di same name wey en papa gi-am before.
bikos dem don distroy di farm wey dey near Heshbon kon skata di vineyard for Sibmah. Yes! Di rulers for di nashons skata di vines go rish Jazer kon enter di desert, den cross di sea.
Dis na wetin God tok about Moab pipol: “Betta wahala dey kom meet Nebo pipol, bikos dem don distroy and seize Kiriataim town. Dem don skata en strong wall kon make di pipol dey shame.
Yu go die for dat mountin wey yu go klimb kon go join yor grand-grand papa dem, just as Aaron yor broda die on-top Mount Hor kon join en grand-grand papa,