23 “But if una nor do wetin una promise, I dey warn una, bikos na sin una don kommit against God bi dat. Make una nor konfuse unasef; bikos una go must get di ponishment for una sin.
“Nor bi true sey if yu do wetin dey write, body go sweet yu? But if yu nor do wetin dey write, dat mean sey sin dey knock for yor door, bikos e won rule yu, but make yu nor allow am.”
Judah ansa, “My oga, wetin wi go fit tell yu? Wetin wi go fit tok? How wi go fit take free awasef? God don espose awa sin! My oga, wi don bi yor savant, wi and di pesin wey dem si di cup for en sak.”
God go ponish Joab for doz pipol wey e kill, wey David my papa nor know about. Joab kill two innocent men wey betta pass am: Abner wey bi Israel soja kommander and Amasa wey dey kommand Judah sojas.
So di sailors kon sey, “Make wi trow dice take know di pesin wey dey kause dis wahala for us.” So dem trow dice and e kon show sey na Jonah dey kause am.
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
Joshua sey make Zabdi Family kom man by man and God kon choose Akan wey en papa na Karmi and Karmi papa na Zabdi wey bi Zera pikin and Zera kom from Judah tribe wey God choose.