Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 32:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 and wi take di land as awa own, den una fit kom back, bikos una don do di work wey una suppose do for God and for Israel pipol. Den God go give una di land wey dey east for Jordan River.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 32:22
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen David hear wetin happen, e sey, “God know sey mi and my men hand nor dey Abner deat.


E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house.


“Wen una don enter di land wey dey Kanaan wey I go give una to stay and I kon put diziz for di house wey una won stay,


and all una sojas cross Jordan River as God kommand kon attack awa enemies until God defeat dem


Una must fight until God make una pipol win, just as E do for una and dem go kollect di land wey God give dem for di oda side for Jordan River. Den una fit go back to una own land wey I don give una.”


until God don give una brodas where dem go stay like una and until una win di land wey di Oga una God don sey E go give dem. Den una fit go back to una place wey Moses, God savant don give una for Jordan River east.”


God give Libnah to Joshua and en sojas and dem kill evribody wey dey stay der; evribody die finish. Dem kon do en king as dem do to Jeriko king.


Joshua katch all dis kings and dia land for just one fight, bikos di Oga wey bi Israel God dey fight for en pipol.


Joshua win di whole land, just as God promise Moses. Den Joshua give di difren tribe for Israel di land, as dia own. Den di land kon get peace and di war kon stop.


Di oda half of Manasseh tribe, Reuben tribe and Gad tribe don kollect dia land wey dey di oda side for Jordan River, just as God savant Moses divide am.


Israel pipol gada for Shiloh and dem kon build di tent where dem for dey meet, for der. Aldo dem don win di land,


Anybody wey kom out from yor house, na-im kill ensef bi dat, so dat one nor go bi awa fault! But if anytin happen to anybody inside yor house, den make yu blame us.


Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east.


So Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon leave Israel pipol for Shiloh wey dey Kanaan, den dem go dia own house for Gilead wey God give dem thru Moses.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ