Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 31:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Dem kill di five kings for Midian wey bi Evi, Rekem, Zur, Hur and Reba. Dem still kill Balaam wey Beor born.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 31:8
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wiked pipol dey porshu and ponish poor pipol. So make di evil trap wey dem set for oda pipol, katch dem.


Dem don know God naw, bikos E dey judge well and naw, wiked pipol dey fall enter dia own trap.


Na trut dey guide yu if yu dey good; but pipol wey dem nor fit trust, na dia own wayo dey distroy dem.


Na manaja wey nor get sense dey enter trobol, but betta manaja dey bring progress.


I si Kushan pipol dey fear and as Midian pipol dey waka dem kon dey fall.


Balaam ansa, “Balak wey Zippor born, wey bi di king for Moab, naim send dem kom meet mi sey,


Den Moab pipol tell di eldas for Midian sey, “Dis plenty pipol go kon distroy evritin wey wi get, just as melu take dey chop grass for field.” Naw, King Balak wey Zippor born wey dey rule Moab pipol for dat time


kon send messenjas go koll Balaam wey Beor born for Petor, wey dey near di river for en town sey, “Si, one nashon don komot from Egypt. Dem plenty well-well for di eart and dem dey stay klose to mi.


Who go fit kount Jakob dust, dem too many to kount. Make I die as God pikin; make I die in peace as betta man.”


I dey go meet my pipol naw, but make I warn yu about wetin dis pipol go soon do yor pipol.”


Di Midian woman wey dem kill, na Cozbi wey Zur born. Zur na leader for Midian tribe.


bikos dem bring wahala to una wen dem deceive una koncerning Peor and bikos of Cozbi, wey die for di time wey Peor bring wahala enter una land.”


Remember sey na dis wimen obey wetin Balaam tok for Peor kon make di pipol sin against God. Dat na wetin curse wahala for God pipol.


Israel pipol katch all di wimen and shidren for Midian kon karry all dia animals, propaty


Since dem komot from di rite way, dem don miss road, bikos dem dey follow Balaam, Beor pikin, wey love bad tins!


Curse dey dia head! Bikos dem dey bihave like Kain and bikos of long-trot, dem dey do di mistake wey Balaam do. So dem go must die like Korah, wey disobey God.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


But dis na wetin I get against yu: yu get some pipol wey dey follow wetin Balaam dey tish and na Balaam tell Balak sey make e curse wahala for Israel pipol. Na-im make dem sin wen e sey make dem chop juju food kon sleep with who nor bi dia husband or wife.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ