Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 31:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 From di ones wey dem give di oda pipol, make yu take one from evry fifty prisona and na di same tin for di animals. Yu go give all of dem to Levi pipol wey dey kare for Tabanako.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 31:30
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na dem dey kare for di tent where dem for dey meet and di holy place. Dem still dey help dia brodas wey bi Aaron shidren-shidren, wey dey serve for God Temple.


Dem still attack doz wey dey keep animals for di towns kon karry many sheep and kamel go back to Jerusalem.


But Levi pipol go kamp near di Tabanako to guide am, so dat nobody go-go near am kon make God strike Israel pipol.”


Di work wey Gershon pipol go do for di tent na to kare for di Tabanako, di tent kover; both for inside and outside, di curtain wey dey di tent gate where dem for dey do meetin,


Dia work na to kare for di box, tabol, lampstand, di altars and di tools wey di priest dey use for di Holy Place. Dia work na to kare for evritin wey dey dia list.


From di sojas own, make yu take God tax komot; one from evry five hundred prisona and na di same tin for di animals.


Make yu give Eleazar all of dem as special ofrin to God.


So Moses and Eleazar kon do wetin God kommand.


Dem fit help dia brodas for di work; dey give dem wetin dem wont, but make dem nor do any work. Dis na wetin yu go tell Levi pipol to do koncerning dia work for di sanctuary.”


Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.


Make una tell Arkippus sey, make e finish di work wey Christ gi-am.


Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.


and from dat day go, e kon make dem dey kut wood and karry wota for di kommunity and for God altar. Till today, dem still dey do dis work for where God choose sey, make dem dey woship am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ