23 and evritin wey go fit pass thru fire, naim una go put for fire, so dat dem go dey holy, but anytin wey una nor fit put for fire, una go-go wosh am with wota.
Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.
Anytin wey dem fall put wen dem die go dey unklean; weda na wood, klot, leda or sak. Doz tins nor dey yuzful again. Even wen dem deep am for wota, e go still dey unklean till evening.
I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”
Den di man wey dey klean, go kollect di melu ashes kon go keep dem for klean place for outside di kamp and Israel pipol go use dem take prepare di wota wey dem go take make pipol holy. Dem dey do dis sakrifice to remove sin.
Dis na how yu go take make dem holy: Sprinkol di holy wota for dia body, den tell dem sey make dem shave di hair for dia whole body kon wosh dia klot, so dat dem go dey holy.
“I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.
Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.
Dis show how baptizim go save us, nor bi just to wosh dirty komot for pesin body, but na to show sey wi get good mind for God thru di way wey Jesus Christ take raiz-up
So I advise yu sey make yu buy gold; gold wey dem don polish with fire. Den yu go get plenty money. Make yu still buy white klot from mi kon wear am, so dat dem nor go si yor nakednes again, den buy medicine put for yor eye, so dat yu go fit si.