22 ‘Na only di gold, silva, bronze, iron, tin, lead
Naw, Zillah still born Tubal-Kain wey dey melt iron, make difren tools: swod, knife both from bronze and iron. Tubal-Kain sista name na Naamah.
Na from groun dem for dey dig iron and melt koppa.
Moses, Eleazar and all di oda leaders for di kommunity kon komot from di kamp go meet di sojas.
Eleazar di priest kon tell di men wey kom back from war sey, “Dis na di law wey God give Moses:
and evritin wey go fit pass thru fire, naim una go put for fire, so dat dem go dey holy, but anytin wey una nor fit put for fire, una go-go wosh am with wota.
All di gold and silva, plus di bronze and all di iron tins, na God get dem. All of dem must go God store house.”
But Israel pipol keep all Ai tins and animals for demsef, just as God tell Joshua.