Oda pipol go help Israel pipol kom back to dia land. Israel pipol go kom back to di land wey God give dem and pipol go serve dem. Den Israel pipol go opress doz wey bin katch dem kon rule di pipol wey bin sofa dem.
“Naw all of una wey don kill pesin or wey tosh dead body go stay outside di kamp for seven days and for di third and sevent day, make una and di wimen wey una katch klean unasef.
But una fit take all di wimen, shidren, animals and oda tins wey una fit take. Make una enjoy all di tins wey una take from una enemies land wey God dey give una.