Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nombas 30:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 So en husband get di rite to gri or nor gri make e do wetin e vow or promise.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nombas 30:13
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For where wi dey for Ahava River, I kon orda sey make all of us fast and honbol awasef before God and make wi ask am make E lead and protet us, awa shidren, all awa propaty and for awa journey.


Wen dem dey sick, I dey sorry for dem. I dey ponish mysef as I dey fast for dem. If I dey lie, make God nor ansa my prayers!


Na di kind fasting wey I choose bi dis? Na only di time wey una dey fast una dey-dey honbol? Na just to skrape di hair for una head rish groun, I wont? Abi, na to just wear sak kon sleep for ashes? Na dis one una dey koll fasting, di day wey God wont?


“Dis na di law wey una go obey forever. For di tent day for di sevent mont, Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem must fast and dem must nor do any work.


“Di tent day for di sevent mont go bi di day to pray make God forgive una. Una go gada woship and una nor go chop anytin, but una go give ofrin to God.


Dat day na Sabat Day, so una must rest and una must honbol unasef for di ninet day for di mont for evening and from dat evening still di next morning, una must respet di Sabat Day.”


“ ‘Make una gada woship God for di tent day for di sevent mont and make una nor chop food or do any work.


But if en husband nor gri make e do wetin e vow or promise, e fit nor do am and God go forgi-am, bikos na en husband nor gri make e do am.


But if di day afta e hear about di vow, e nor tok anytin, e must do evritin wey e vow or promise and since e nor tok anytin for di day wen e hear about am, e don agri with di vow wey di woman make.


but I wont make una undastand sey as Christ bi evribody head, na so too husband bi head for en house and na God bi Christ head.


God nor kreate man bikos of woman, but E kreate woman, bikos of man.


Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ