50 E kollect 1,365 pieces for silva to take buy di first-born for Israel (each of di money na as dem dey measure am with di sanctuary shekel).
So Moses kollect silva kon buy di first-born for Israel back wey many pass Levi own.
Den e take di money go give Aaron and en sons, just as God kommand am.
just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”
E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.
Na wons Jesus enter di place wey holy pass. E nor enter with goat or ram blood, but na with en own blood, so e don save us forever and ever.
Una know sey, God free una from di empty life wey una kollect from una grand-grand papa dem and E nor buy una with sometin wey fit spoil like silva or gold,
Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.