Una fit take donkey first-born from God if una gi-am one lamb or yong goat. But if una nor kollect am back, una must break en neck. But una must buy una first son back.
Wen Fero nor gri free us, di Oga awa God kon kill all di first sons for Egypt, both human being and animal. Dis na di rizin why wi dey sakrifice all di first-born son give God, but wi dey buy dem back.’