8 But una must give burnt ofrin to God; di smell wey God dey like: una go give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
For di first day, una go give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: una go give thirteen yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
Make una give burnt ofrin to God, di smell wey God go like: make una give one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and all of dem must dey okay.
But if di first pikin for di animal get problem like sey e nor fit waka or e blind or if any oda tin dey happen to am, make una nor sakrifice am give di Oga una God.