40 So Moses tell Israel pipol evritin wey God kommand am.
Dis na wetin Moses do akordin to evritin wey God kommand am.
“ ‘Dis na di law for burnt, grain, wine and fellowship ofrin wey una go give God wen una dey do di feast. Dis ones join di ofrin wey una go give to fulfil di vow or as free will ofrin.’ ”
All di leaders for di tribe, Moses kon tell dem about Israel pipol sey, “Dis na wetin God kommand:
dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”
Bikos I nor hide anytin from una, as I dey tell una about God plan.
Bikos na wetin I receive, naim bi di first important tin wey I give una; sey Christ die for awa sins as dem rite for God word
Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay.
E obey God wey choose am as High Priest, just as Moses obey God.
True-true, Moses really obey God as savant and e tok about some tins wey God go tok about leta.