37 with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
Make una give food ofrin to God, di smell wey God like well-well: one yong melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.