Di king give some of en animals as burnt sakrifice, with di morning and evening burnt sakrifice and di sakrifice wey dem dey burn for Sabat Day, New Moon and any oda time wey dem rite for God Law Book.
Na en work to bring di animal wey dem go burn, di korn ofrin for di New Moon Festival, di Sabat Day and di oda festivals. Na en go provide di ofrin for sins; di korn ofrins, di full animal wey dem go burn as ofrin and di fellowship ofrin, so dat God go forgive Israel pipol dia sins.”