25 Una go add one man goat join am to take make di pipol holy, plus di evriday burnt ofrin with en grain and wine ofrin.
So dem take Josef koat kon kill one small goat, den soak am inside di blood.
Make una still give one man goat as sin ofrin and like dis, una go make di pipol holy and una go still give di evriday burnt ofrin with en korn ofrin.
with dia grain and wine ofrin, di melu, ram and di lamb, akordin to di nomba wey dem tok.
“ ‘For di fift day, make una give nine melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,
Jesus kon tell di pipol wey kom from Judea wey bilive am, “If una obey wetin I dey tish una, den una go bi my disciples
Wen di meetin for di sinagog don finish, many Jew and Gentile pipol wey dey fear God kon follow Paul and Banabas, dey enkourage dem sey, make dem kontinue for di grace wey God give dem.
God go give life wey nor dey end to di pipol wey dey do good, wey wont glory, honor and long life.
But wi nor give dem shance, so dat di trut wey dey di gospel, go last for una.
So make to do good, nor taya us, bikos wen time rish, wi go gain am.
My brodas and sistas, make e nor taya una to do good.
Wi nor dey among pipol wey go turn back kon perish, but wi get faith wey go save us forever.
True Christ, make wi kontinue to dey give God praiz as awa sakrifice. So, make wetin dey kom out from awa mout bi, “Na Jesus, bi Oga God.”
Bikos wi go bi Jesus Christ friend, if wi whole awa faith strong go rish di end.